Victor Osimhen blasts Finidi George in WCQ call up row

Advertisements
Spread the love

 

Super Eagles’ striker, Victor Osimhen, has poured venom on embattled former senior national team handler, Finidi George, over his comments after the disgraceful run in the 2026 FIFA World Cup Qualifiers.

The forward, in a no holds barred live feed on Facebook, declared on Saturday that he had lost respect for George.

Osimhen said this stemmed from his feeding the press with wrong information about him after Nigeria lost to Benin Republic in Côte d’Ivoire in a 2026 World Cup qualifying match.

Advertisements

The livid SSC Napoli striker in the post said in a mixture of English and pidgin: “The respect that I have for that man I don lose am now.

“All these things, I get am for video.

“I tell am that he should allow me come to camp and talk to the boys.

“He said no.

“That I should be with the family.

“Team don lose now, una no see who to blame, but nah me Osimhen.

“Una no go die better.

“Una no find person wey dey at fault, nah me wey dey nurse my injury.

“Nah me una think say una put my name because Super Eagles get two bad games.

“You (Finidi) come dey talk say you can’t beg.

“Who dey beg who?

“Who come see me when we play 4-4 against Sierra Leone?

“When my nerves dey damaged?

“I no get who I set dear for this life.

“I only give people their respect.

“I swear to God who made me.

“Nah the reason wey I no get godfather be that.

“I’m not in that stage wey I go say help me beg this man so that I go dey play.

“I no dey for that nonsense.

“I no dey that rubbish.

“I go post all those evidence because I know say this day go come.

“Nah why I do those videos, take those screenshots wey I go post now.

“Because I no go keep quiet again.

“No soul I dey fear for this world.

“Na respect I get and if you disrespect me, I go lose am.

“Na so I dey.

“If these things wey I dey talk no go make me come back to Super Eagles again, so be it.

“Super Eagles no be my father get am.

“No be Baba Andrew get am.

“I come there meet Ighalo dey do great things for there.

“Ighalo meet Martins dem dey do great things for there.

“Ighalo leave am, I take am.

“Super Eagles no be my papa house.

“Everybody go come to do their bit and go their ways.

“But I no go come allow person to tell me say you cannot beg Osimhen to play.

“You cannot beg wetin?

“Make I show the message I sent to our Doctor wey I dey ask am say if I dey 10 days, she I fit dey okay to play the match?

“How many messages I send when they appoint you (Finidi).

“I sent you message personally to say congratulations, make we achieve great things together.

“I messaged you.

“Abi I no message am?

“No involve me at all.”